Mommyyyy… you mellow this morning o. Hope nothing dey pa?. How far mommy. This one wey you call me so for early mor mor
Sharraap. You nor happy I call you?. I hia say you rite buku say
Waiting for my hosbans to die. Na which womans dey wait for im hosbans
to peme?. Na wa for you and dat buku. You go sell so?
Haba madam. How you take don hia nah… I be wan ask make you waka come be Chief Launcher na! But you jus comot word for my mouth
Dat your smelly smelly maut. You dey aks me who tells me. You forget say I be fes lady. I dey hia eferythins about my friends
Eyyaaahh!!! So I be your friend. You come leave me go waka
dey dance with baba Iyabo. Na wa o, madam. You fall my hand sha. Friends
don’t let friends dance with retired Presidents na.
Jebose if I slap you?. Idiot. I say you be nonsense pikins.
Scaliwag like you. Make me I dance with you?. Church rat of Onicha Ugbo.
Hmmm. It is not your folt o. I swear. Na me carry my Etisalat begin
call your yeye China made Nokia flipu fone. Alakoba
Madam the tin wey pain me be say you come dey hold baba
iyabo tight sef for dance floor. I beg where Oga Jonathan dey wey you
dey tap agbalagba current?
Oloriburuku omo ale. If i hole am nkor. Na only me waka come nah.
Jebose, wetin konsan you if i dance hole tait with Daddi Iyabo. I say
wetin konsan you. You nor be my hosbans. Or you be my boi
frens?.Mscheeww.. which kain korent you say I tabu… baba nor get korent
o.
Eh. Madam cool down nah. Make I talk my own. Body just dey
pain me. How old man go dey gbadun you like dat and I dey hia dey dream
and provoke.
Jelosi don kee Jebose. I go report you to Alhaja. Daleru. You wan
scatter my hause. I beg wetin you get. Wai I go dance with you?. You wey
be Common reporter. You nor get agbara reach baba OBJ. You nor be
former presidence of Naija two timeses. One wey be soja boy and the
other be civilian presidence wey we waka enter democrasi. You nor get
money. You nor sabi plenty peoples. You nor get korneshion… Common buy
recharge card for your yeye Glo line, you nor get money for recharge.
Your fine gel pikin still dey drink SMA made in Alaba. Make you hia nau.
Baba Iyabo na im get Naija. Na only him fit tell EFCC make dem free me
and my hosbans Jonathan. Baba Iyabo be power and privilege. You na jus
gbeborun. So anyhow baba want, I go dash am. If your bodi dey pain you,
go aks your papa PMB make im give you APC melesine. See as una dabaru
Nigeria since your papa come with jibiti shange. I beg Jebose, levu don
shange. Free me. Let me be. Daddi Iyabo be my latest bes frens. If you
like you can go and die. I nor send you.
Hia… mommy so na so you go take do me. Remember sha, no condition is permanent o. I fit be President tomorrow
Hehehehehehe…makeuna see Jebose O… Egba mi O. You, be President
tomorrow?. Make you sidon dia dey wait for tomorrow nah. Your own
kondishion na pamanence becos since I sabi you, you never shange: You
still dey live for that your foolish face me, I face you room and parlor
for Mushin, dey que for 4a.m in the morin to go shit and baff becos na
only one toilet and baffroom dey for the face me I face you hause. And
you don live for the same hause since I sabi you. So your own kondishion
dey pamanence…
Madam, God dey O. All this dance you are sharing, Dia is Allah O
Which Allah? Omashe o. So Alhaja don konvashion you to Muslim?.
Eyyaahh. Your own don finish. No wonder I see dat foto wey you be like
Almajiri for Kano. No wonder you dey follow PMB. You see unaself?. Pesin
nor see pentro. Nigerians dey sofa. Your broda, Kachikwu wey dem put in
charge of our oyel say im nor be majishan… Nigerians nor get eletriciti
to charge fone. Pentro nor dey to enjoi life ni ile wa. God don ponish
una wey comot my hosban. Una don see shange nah. Very soon una go begin
see credit. I beg I wan call Daddi Iyabo make I see where the nest parry
dey so I go dance with am. Jebose, comot for my fone, I beg.
Gerraaauutt. CLICK.
This article was written by Azuka Jebose
No comments:
Post a Comment